Tuesday, 28 July 2015

BREAKING NEWS!! BOKO HARAM BEG PRESIDO BUHARI FOR FORGIVENESS!!

According to latest informate Wey just comot, one group for terrorist Boko Haram don beg presido for forgiveness and dem ready to negotiate with am.
According to presido Buhari oga for talk talk matter Garba Shehu, the group don send message to the presido and dem ready to Negotiate.

According to Shehu dem wan make sure say the group dey real and dem get all the powers Wey dem yarn say dem get before government start negotiations.
Presido Buhari Muhammadu don yarn say Hin go like to negotiate with Boko Haram so that dem go fit bring back the more than 200 girls Wey dem kidnap last year for Chibok

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.