Saturday 25 April 2015

KIM KARDASHIAN DON RECOGNIZE SAY BRUCE JENNER NA WOMAN NOW!!

Bruce yesterday do interview yesterday with Diane sawyer wey hin talk say hin no be man again and him be woman.
I go try explain:
Bruce wey many people don talk sat hin wan change to woman after hin don live as man for 65 years don announce hin dey change to woman.

Bruce yarn say hin soul na woman own and hin don dey lie all through hin life. Hin talk throughout hin life, hin dey always behave like woman and him be more woman than man.

Bruce wey dey cry as hin dey talk this tin in front of four of hin pikin dem. Hin talk say hin no be gay and hin no like men and hin dey always dey with women for sex, but that one no mean say hin be man. Hin talk say hin no comot quick to talk true because hin dey fear wetin people go talk.


Kim don go instagram to recognize say her step papa for more than 20 years na woman. Kim wey according to Bruce support am with her husband Kanye west so that hin go comot talk true.


E-more

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.