Saturday, 24 January 2015

TOP 10 NAIJA VOCALIST

After how many weeks of preparation, the list don finally come out and na Na him be this.
People wey no enter this list, make una no vex na based on our opinion as we dey find voice wey fit represent  naija for anywhere for this world.some people wey no make this list Milli, 2face, BEZ, cobhams asuquo,etc.
The people wey do this list na Weird mc, Dj boss beat,  Adebiyi Adetola(mr Nig intl 2013), Dj Andy and Emore.

10. GABRIEL AFOLAYAN

Popular Naija actor Gabriel afolayan wey don dey sing now na him be number 10 for this list.Gabriel enter this list with the power wey hin get for hin voice and the different ways wey hin dey use hin voice.Gabriel beat a lot of popular musician to enter this list.
best voice work: kokoro ife


9. GT THE GUITARMAN

GT the guitarman enter this list because of hin sweet and calm voice. Gt wey we sabi na lover boy and hin love songs dey make all the women dey want to dey hear am. Gt enter Naija industry with hin popular song "dreamer" and since that time everybody wan hear am. GT don come back industry with hin new album "Baked"
best voice song:truly

8.SOJAY
Many of una no go know Sojay wey dey trybe records, but i fit tell una say Sojay get one of the best voice for Naija. The main thing wey bring Sojay come this list na the differnt ways hin dey use hin voice and the power wey hin get when hin use "falsetto".
Best voice work: beneath your beautiful(cover)

7.CAPITAL FEMI
Capital FEMI na one of the best songwriters for naija, but apart from that one hin voice dey very nice and hin sabi sing wella. Capital FEMi enter industry with the kind songs wey hin dey sing as many people don find that kind song and hin come get the voice to carry am. Capital FEMI no dey lazy when hin dey sing as hin fit do anything with hin voice.
Best voice work:

6 .IYANYA
Iyanya na him be the  first winner of project fame wey be the best singing competition for Naija, Iyanya sabi sain. Iyanya enter industry with Hin love you truly sing wey everybody like and almost everybody go agree say na hin best work
Best voice work: love you truly

5: Darey Art Alade

Darey Art Alade na one of the Naija R'N"B king. Darey get voice especially with hin deep range. Darey study Music for University of Lagos and so hin sabi the confirm things whhen hin dey sing. Darey call himself the Naija King of R'N'B and some people no go argue.
Best voice work: Not the girl

4 BANKY W
We no need to talk much about Banky W, when we dey talk about singing for Naija Banky W dey another level. Banky dey always deliver especially when e reach hin "falsetto". Banky W na one of Naija R'N'B people wey fit represent us anywhere for this world.
Best voice work: don't break my heart
3. WANDE COAL
From Ololufe to Baby hello, Wande coal na one of the Naija Artist wey get super-voice. Wande coal voice some people talk say na the most special voice for Naija. No arguement say Wande na deserve this position
best work: ololufe
2.PRAIZ
praiz na of the best singer wey we get for naija, praiz start with this hin |R'N'B. Praiz voice na one of the best when hin go low and when hin go high
Best voice work: Afurumginaya

1.TIMI DAKOLO

 Timi dakolo na the naija vocalist wey dey very very different. After hin wonderful voice win West African Idols for am, Timi hit the industry with hin tight voice. Timi no just dey naija, you fit carry am go anywhere for this voice and hin go perform wella.Most people go argue am but I feel say Timi na one of the best for this world.E dey very hard to choose Timi best work because hin dey always deliver.
Best voice work: great Nation.

                                                                    
                                                                          

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.