Monday, 27 July 2015

PRESIDO BUHARI MEETING WITH HOUSE OF REP MEMBERS NO SOLVE ANY PROBLEM


The meeting wey Presido Buhari do with APC house of Representative members today monday no solve anything and the problem wey dey for the National Assembly still continue especially for the House of Representatives.


At the end of the meeting wey last for Only 20 minutes , the members of the house no change mouth from wey dem bin dey before. The house members still dey for two groups as one dey support Dogara for speaker and the other one dey against dem. Dem no even change mouth even as Oga presido Buhari follow dem yarn.

Former Minority leader, Femi Gbajamiamila yarn say the meeting na about the Party and how dem go continue to rule Naija. Hin even yarn say before the end of today dem go yarn Nigerians about the meeting today. Hin yarn say dem still dey yarn and this na the first time wey the two groups go dey together to talk about the problem.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.