Friday 31 July 2015

I NO DEY EXPECT TO BECOME MINISTER---- TUNDE BAKARE

The General Overseer of popular Lagos church, Latter Rain assembly and Presido Buhari VP when hin contest for 2011 don yarn say hin no dey expect to become minister for the new Buhari government.
Pastor. Bakare talk this one as hin dey follow Sahara TV dey yarn.

'As far as I dey concerned, I no dey expect to become minister, If dem give me the appointment, when we reach that bridge we go cross am. I be minister already, I be minister of the word of God. Ministry na my calling and the word minister mean servant. When you dey expect nothing, you no fit get disappointment. I go dey do wetin I dey do and I go dey support Presido Buhari and wetin hin support. I no regret wetin I do for 2011. If another opportunity come, I go do am again.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.