Sunday 17 May 2015

69 CHRISTIANS DON DIE FOR PLATEAU STATE

69 Christians and one pastor don die for Plateau state. The attacks wey people yarn say na Fulani people wey dey keep cattle "herdsmen" because dem dey fight for "JIHAD" don dey come for some weeks.
The attack for May 2nd kill 27 Christians and dem burn Church of Christ in nations (COCIN) for Barkin lada local government area. The attack kill Rev. Luka Gwom and one lady Pauline, wey just do her marriage 2 weeks before that day.
For one week from April 25 to May 11 dem don attack 8 villages and don kill pass 69 people. Dem don attack one village more than once.
The plateau state government no dey take the matter seriously as if na ordinary tin. One of the villagers yarn say the attack dey come almost everyday and people dey die everyday.

Full tori from Vanguard Newspaper.

No comments:

Post a Comment

This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.

Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.