See this one:
Every
where,
Even
before before for Naija
Dem
dey take honour
Tell
country people
Wey
do better thing dem
Well
done.
Person
do better sport
Dem
go take honour
Tell
am well done.
Person
write better write write
Dem
go take honour
Tell
am well done.
Person
play better politics
Dem
go take honour
Tell
am well done.
Person
do better business
Na
honour dem go take
Tell
am well done.
Better
every every
Dem
go take honour say
Well
done.
Now
di moto don enter reverse,
Now
Naija
dey dishonour honour.
Today
dem go catch country person
Wey
dey thief Naija money,
Tomorrow
dem go carry am go court.
Next
tomorrow
Court
go give am bail,
Case
file go waka,
Case
go finish.
Next
year
Di
country person
Go
show for honour,
Naija
dey dishonour honour.
The person wey write am na Chidi Anthony opara see more for here
No comments:
Post a Comment
This comment no show wetin ITK think about this post. Please no put words wey no good for una comment.Thank you.
Call +2348188393890
Or send Una email to emoreitk@gmail to advertise and for any informate.