Sunday, 16 August 2015

NAWA!! SEE THE SUFFER FOR FOR THIS IDP CAMP FOR ABUJA



 Nawa, the government no dey even take care of this people at all. Kayode Ogundamisi wey bisit the camp na hin give me the pictures. look more after the break.

WHO MISS ME?



I dey sorry say i no fit blog throughout yesterday,and una know say na only me dey post for this blog. I go start to post now

LOOK SINGER SEYI SHAY BRAND NEW TATOO FOR BODY


 The singer don get new tattoo for body and the tattoo na for chinese but the meaning na ' music'. You think say na just show say she love her work or e just dey too much?. Look another picture after the break.

Friday, 14 August 2015

STOP THE RUMOURS!! FIVE STAR MUSIC ARTIST SKIBBI NEVER DIE

So I dey work and as normal I never fit post put today one Popular blog spread the rumour say Five star music artist Skibii don die. According to wetin Five star music Manager Soso Soberekan tell me today be say, Skibii faint but hin still dey alive.

So stop to spread the rumour!

MAMA OF F;AVOUR PIKIN, SANDRA STILL LOVE FLAVOUR?



Sandra post this picture come write, Ugbebe Oyibo Chinedu, #Gollibe. Chinedu na Flavour real name and I no understand Igbo but e fit be say she dey talk about am. Abeg who fit help me interprete am?

SEE HOW AMBER ROSE DEY WHEN SHE BE SMALL PIKIN



This picture show say anybody fit become anything as far as say dem wan do am.

MAKE UNA STOP BOKO HARAM FOR THE NEXT 3 MONTHS; BUHARI YARN NEW SC


Presido Buhari don yarn say make dem try to stop Boko Haram for the next 3 months make the new Service chiefs try to stop wey don kill many people for the country.
Presido Buhari yarn

' As we go troway salute to the soldiers dem for wetin dem don do so far, una need to continue to join head together with other people for the country so that we go get better plan and like that we go fit fight Boko Haram and fit stop am for the  next three months.

PHOTO: SPEAKER, YAKUBU DOGARA VISIT VP YEMI OSINBAJO


 House of Representatives speaker, Yakubu Dogara visit Vice-presido Prof. Yemi Osinbajo, SAN for hin office for Aso rock villa. Look more after the break.

TONTO DIKE DON DENY SAY SHE CARRY BELLE


Actress Tonto Dike don deny wetin people dey talk say she get belle when she yarn Encomium weekly magazine. She talk say the Instagram account wey dey post pictures say she get belle na fake and no be she get the account.

PHOTOS: WETIN REMAIN FOR THE HELICOPTER AFTER THE CRASH


  The Helicopter crash on wednesday, Aug 12th inside Lagoon for  Oworoshoki side, Lagos. Look another photo after the break.

ENIOLA BADMUS AND HER NOSE RING COMOT FOR BLACK/ WHITE

Enilola share this picture yesterday for her Instagram page. You no need to be slim to look good.

SEAN TIZZLE AND FEMI OTEDOLA DAUGHTER, DJ CUPPY DEY DATE!!


If dem no dey date then which kind friendship be this?

Sean post this picture for hin Instagram page come write say ' God bless my cupcake ifeoluwa aka cuppy. E no finish hin come dey compare dem relationship to Jay-Z and Beyonce dem. Hin come dey call am hin future wife, '#Future Abiamo #MyAbiamokindagirl #kisses'

So we don get another celeb couple?

KYLIE JENNER AND TYGA FINALLY HOLD DEM HAND TOGETHER FOR PEOPLE FRONT

Kylie don become, 18 years old now and so na adult now and nothing to hide. Look another picture after the break.

Thursday, 13 August 2015

OSITA IHEME 'PAWPAW' WAN START HOTEL BUSINESS


Osita share this picture for Instagram from the site of hin new hotel business. Osita wey don invest for transport business dey invest more than 30 million for this new one. Osita na sharp business man.

CRISTIANO RONALDO PIKIN SHOW OFF HIN PAPA LAMBORGHINI


The madrid player , share this picture of hin pikin Cristiano Ronaldo Jr as hin dey stand with am near hin Lamborghini. Like papa like pikin!